83-year-old Zimbabwe President Mnangagwa sign law wey go keep am for power till 2030
Published 23 minutes wey don pass
Read am in 2 mins
Zimbabwe President Emmerson Mnangagwa don sign into law one constitutional amendment Act wey extend im term for office to 2030.
Tok-tok pesin to di govment Nick Mangwana confam dis development on Tuesday.
“Signed, sealed and delivered – e be law now,” Mnangagwa tok for one post on X, and e attach copy of di legislation to di post.
Di law also cancel direct presidential elections, and introduce one process wey be say na parliament go choose future presidents.
Wetin dis new law mean na say instead of President Mnangagwa tenure to end for 2028, e go rule till 2030. E also don effectively end di presidential ambitions of Vice President General Constantino Chiwenga through di electoral process, as na parliaments go dey choose future leaders.
Na for June, both di Senate and di House of Representatives for di Southern African kontri pass di bill to extend di presidential term for office from five to seven years, wey go allow President Emmerson Mnangagwa to remain in power until 2030.
More dan 200 lawmakers bin in favour of di draft legislation. Di vote pass di threshold wey dey required for a two-thirds majority to amend di constitution.
83-year-old Mnangagwa bin take ova power for 2017 afta e comot long-time ruler Robert Mugabe wit di support of di military – and e go on to win disputed elections for 2018 and 2023.
Source: BBC
